Burna Boy 20 10 20 Lyrics

 Burna Boy 20 10 20 Lyrics


Shey you never hear

About the things wey happen there

Abi your eye never clear

Mankind so wicked

Lets talk about my government

Open your mind and your ears

Wetin happen

Shey na jazz o

Make my people suffer suffer

All their nyanshes don dey open

Everything don scatter scatter


20th of October 2020

You carry army go kill many youth for Lekki

Na so water ooo water runaway my eyes

Nothing you go talk wey go justify the case of their murder


The Chief of Staff, the commander and the army wey carry order

Mr President, Mr Governor

Godfather, gbo gbo ijoba

All your atrocity

All of your corner corner

Make all the deadbody disturb you for your dream


The money wey you thief yapa for your azza

You don turn our graduates to common beggars

All the book them go no matter

'Cause you no go get job if you no know godfather


The Chief of Staff, the commander and the army wey carry order

Mr President, Mr Governor

Godfather, gbo gbo IJOBA

All your atrocity

All of your corner corner

Make all the deadbody disturb you for your dream


20th of October 2020

You carry army go kill many youth for Lekki

Na so water ooo water runaway my eyes

Nothing you go talk wey go justify the case of their murder


We give them many chances

Dem fail my people

And When we cry for justice

Them kill my people

Walahi all of you

Their lives are on you

We no go ever forget all the youths

Wey die for tollgate


20th of October 2020




Previous Post Next Post